Eedris Abdulkareem- Jaga Jaga(Reloaded) Ft. Nigga Raw, Mardarocka (Audio, Video, Lyrics)

Category: Naija HipHop

Jaga Jaga relaoded- Eeedris Abdulkareem

Nigga Raw- Nwane!

Queen Madarocka!

 

Download Jaja Jaga (Reloaded)

 

Verse One:  (Eedris Abdulkareem)

Its been 20 years- Nigeria sill jaga jaga

Dis na democracy- military 

Government don send soja out.....

Kill plenty Lagosians- wey come protest for toll gate...

Kill people for River State....

**********************

Army dey shoot people papa...

Police dey kill people mama...

Dis no bi military regime o...

Buhari remember-- civil war,,

Restructure Nigeria 

Monkey no go work make bamboo dey chop

Federalism na thing wey we want

You ojoro don much

Religion and nepotism na the problem wey you get...

 

Chorus

Nigeria jaga jaga eeh

Everything scatter-scatter eeh

Poor man still dey suffer- suffer eeh

(Gosa gbosa) gunshots in a the air

No more police brutality.... everything jaga jaga eeh

Poor man still dey suffer- suffer eeh

(Gosa gbosa) gunshots in a the air

 

Verse two: (Nigga Raw)

Bonise! bonise! abi no be so?

Our suffering and smiling sef na pasy as you go- go go!

Who no go no go know

The koko thing now na for Pharaoh to let my people go

Tufiakwa!

No single main road dey for South East

Me I can't breath- say our government na our mouth piece

The same people wey hide palliatives

When we dey hungry follow dey shout tire

I pledge to Nigeria my country 

Make I yarn- some people say make I hold my beat

20:10:20 - dey shoot my people for toll gate

And all we did na to beg dem say make dem #EndSARS

Who gave the military order to shoot at protesters?

 

Chorus:

Nigeria jaga jaga eeh

Everything scatter-scatter eeh

Poor man still dey suffer- suffer eeh

(Gosa gbosa) gunshots in a the air

No more police brutality.... everything jaga jaga eeh

Poor man still dey suffer- suffer eeh

(Gosa gbosa) gunshots in a the air

 

Verse four: (Eedris Abdulkareem)

First of all dey tell us say nobody doe for the toll gate

Second of all- they lie to us say two people die for the toll gate

All of a sudden- the military say na governor invite dem

Governor accept say him invite dem but him no tell dem make dem shoot

Who order the shooting o?

Holy ghost fire ponpon dem

Who off light for toll gate o?

Holy ghost fire ponpon dem

Who remove CCTV

Holy ghost fire ponpon dem

People wey say na photoshoot

Holy ghost fire ponpon dem


Chorus:

Nigeria jaga jaga eeh

Everything scatter-scatter eeh

Poor man still dey suffer- suffer eeh

(Gosa gbosa) gunshots in a the air

No more police brutality.... everything jaga jaga eeh

Poor man still dey suffer- suffer eeh

(Gosa gbosa) gunshots in a the air

 

Outtro:

Fel Kuti you remember Kalakuta- Kalakuta ye ye ye ye ye

Obasanjo na you be my father- Baba you don jaga jaga o

Wey Festus Keyamo sef? 

E don dey follow the cabal o

E don dey chop with the cabal o (Hahahahahaha)

 


Download Jaja Jaga (Reloaded)

 

Watch video;



No comments

Powered by Blogger.